While Nigerians and Deltans in particular are yet to come to terms with the death of Obinna Adaeze, the 19 months old baby flogged to death by his teacher, Emeka Joshua at Arise and Shine Nursery and Primary School, Asaba, the proprietor of Kings Foundation School, Sapele, has beaten a 10-year-old girl with wire, inflicting wounds on her body.
Trouble started on Wednesday February 16th 2022, in the school located at 26 OTC Road, Amukpe, Sapele, the administrative headquarter of Sapele local government area of Delta State, when the 10-year-old girl failed to solve a mathematical question with the formula provided by the proprietor.
A post on Thursday February 17th 2022, by a Facebook page, Sapele Matters, alleged that a male teacher in the school, identified as Gift, had abused same 10-year-old girl, which he admitted as a mistake.
See details below:
OWNER OF KINGS FOUNDATION SCHOOLS FOR OTC ROAD FOR AMUKPE NAI FLOG 10 YEARS OLD PIKIN WITH WIRE.
Na yesterday nai report hit us for studio here say na the owner of Kings Foundation Schools wey dey for OTC Road for Amukpe nai flog one girl of 10 years old with wire and her skin peel.
We all know weytin happen for Asaba last week wey dem flog one pikin of One Year 7 months to death, wey lead to the shutting down of the school for Asaba.
And some of us nor wan use our head or use our tongue to take count out teeth.
Just yesterday nai this incident happen for Kings Foundation Schools for Amukpe as the owner of the school claim say the girl nor fit solve Maths with the formula wey he take teach dem yesterday, nai be flog wey he flog the girl with wire and peel her skin.
Before now, we also hear say one of the male teacher for the school wey dem dey call Gift don also use hand take rub the 10 years old girl private part some time ago and the teacher admit say na mistake nai he hand take touch the pikin private part say he nor mean am.
Just as this issue of flogging happen yesterday, the parents of the girl don dey plan to take action against the school.
We dey use this medium to call on Schools for Sapele to minimize the way dem dey flog their pupils or Students as the case maybe.
Make dem find other methods of discipline rather than serious flogging and peeling of skin like this, because nor be all parents go fit take such case easy.